Al-Hilal agree deal wit Paris St-Germain for Neymar

Neymar score for Paris St-Germain for dia pre-season friendly against Jeonbuk Hyundai Motors

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Neymar score for Paris St-Germain for dia pre-season friendly against Jeonbuk Hyundai Motors

Paris St-Germain don agree deal to sell Brazil forward Neymar to Saudi Pro League side Al-Hilal for a fee wey dey about 90m euros (£77.6m) plus add-ons.

Di transfer dey subject to di 31-year-old completing a medical and all necessary paperwork.

Neymar, wey join PSG for a world record fee of 222m euros in 2017, miss di Ligue 1 opener on Saturday.

E no dey part of coach Luis Enrique plans for di new season.

E also fit PSG strategy of moving away from di 'Galacticos' era of signing high-profile players for big money and better salary.

Tori be say Neymar bin dey earn within di region of 25m euros (£21.6m) annually for di French side.

Im don make 173 appearances for PSG, helping di club win 13 trophies, including five Ligue 1 titles, as well as reaching di 2020 Champions League final.

However, im bin dey struggle wit a number of ankle injuries wen im bin dey French capital.

Di former Barcelona player get injury for March wey cause am to miss di rest of di season and bin resume training for July.

Im miss two Brazil matches for di 2022 World Cup afta dem injure am for di group opening match.

Di forward also miss di 2019 Copa America afta suffering injury for im right ankle and im dey out for several weeks in 2021 wit same injury.

News of di Neymar deal dey come just 24 hours after dem don reintegrate Kylian Mbappe from PSG into di first-team training wen his tok wit di club dey positive.

Di 24-year-old France forward, don dey inside different contract tok wen im show desire to join Real Madrid but im fit extend contract for PSG wit im current deal wey go expire next summer.

Last month, PSG give Al-Hilal permission to tok to Mbappe afta di Saudi side make record £259m bid.

If e dey completed, di transfer go kontinu a remarkable summer spending jamboree wey di Saudi clubs don dey do. Dis one mean say di league get ambition to be one of di top competitions in di world for di next few years.

Players like Karim Benzema, N'Golo Kante, Jordan Henderson, Ruben Neves, Sadio Mane and Roberto Firmino don go Saudi Arabia.

Portugal superstar Cristiano Ronaldo bin join Al-Nassr from Manchester United for January.